Hushpuppi Arrested: How Nigeria Instragram celeb Raymond Abass AKA Hushpuppi or Hush appear for US court to face charges of conspiring to launder hundreds of millions of dollars from cybercrime

Hushpuppi Arrested: How Nigeria Instragram celeb Raymond Abass AKA Hushpuppi or Hush appear for US court to face charges of conspiring to launder hundreds of millions of dollars from cybercrime

Raymond Abass alias AKA Hushpuppi or Hush don appear for US court to face Charges of Conspiring to Launder Hundreds of Millions of Dollars from Cybercrime.

Di United States Department of Justice through di U.S. Attorney's Office Central District of California confam on Friday say di Nigerian cyber-crime suspect bin appear for court for di first time for Chicago.

US Department of Justice say dem go transfer di 37-year-old Hushpuppi go Los Angeles to go face criminal charges for di coming weeks.

United Arab Emirates security agencies bin arrest Hushpuppi wey dey live for Dubai last month on top accuse say im dey plan to tiff plenty millions of dollars from business email compromise (BEC), yahoo-yahoo and oda mago-mago and na U.S. law firm, one foreign bank and one English Premier League club be im target.

Dem extradite earlier dis week go America for FBI special agents custody.

Nigerian Instagram star, ‘Ray Hushpuppi’ or Hush real name na Raymond Abass or Raymond Igbalode Abass
Wetin we call dis foto,

Nigerian Instagram star, ‘Ray Hushpuppi’ or Hush real name na Raymond Abass or Raymond Igbalode Abass

If dem find am guilty of di accuse, Abbas go face maximum prison sentence of nothing less than 20 years for federal prison, BBC Pidgin Daniel Semeniworima find out from experts on cybercrime and international law.

Di arrest of Hushpuppi go epp Dubai police solve some cybercrimes mata but e don create problems for some Nigerians wey dey di kontri.

Nigerians youths and business owners wey dey UAE say dia legit business dey at risk as banks fit dey monitor how dem take dey spend money.

Di complaints against Hushpuppi

Nigerian Instagram celebrity, Ramon Olorunwa Abbas alias Hushpuppi or Hush don dey US to face charges on top accuse say im conspire to launder Hundreds of Millions of Dollars from business email compromise, frauds and oda scams wey include plans wey target one U.S law firm, one foreign bank and one English Premier League Soccer club.

Dubai police on Thursday evening extradite di 37 years old Hushpuppy go Chicago, America. He appear for di US Court for Friday morning and dem go later transfer am go Los Angeles.

UAE law enforcement officials arrest Hushpuppi last month for Dubai before dem hand am over to di custody of FBI special agents wey carry am come United States to face accuse of money laundering wey Federal prosecutors for Los Angeles file against am.

For inside di complain dem file against am, FBI Investigation show say na only crime money im fit take dey support di kain life wey im always dey flaunt for social media. Dem say im social media accounts dey always show am for inside designer's clothes, wear expensive wrist watches and he always dey pose inside very expensive rides and charter jets. Di FBI say from dia investigations, dem sabi say Hushpuppi na di oga of one transnational network wey dey into internet fraud, scam and money laundering. Di affidavit show say dia work na to target victims from around di world and tiff big money from dem.

Wetin be BEC

Di affidavit describe Business Email Compromise (BEC) as method wey hackers dey take get unauthorized access to business email accounts. Dem go block or change di direction of di communication wey suppose dey enta or comot from dat email. Dis hackers go turn di email to dia own begin dey take am communicate wit pesin wey dey work for di company to trick am to wire money.

Di United States Attorney Nick Hanna tok say "BEC scheme na one of di most difficult cybercrimes we don see as e involve many yahoo-yahoo pipo wey dey different part of di world wey get experience on how to hack computer and exploit di international financial system".

How much US lose sake of cybercrimes

Assistant Director wey dey in Charge of di FBI Los Angeles Field Office Paul Delacourt say for only 2019 alone, FBI get record of 1.7 billion dollars wey companies and individuals wey be victims of dis cybercrimes lose through dis business email scam, di type wey dem charge Hushpuppy for.

Oga Paul encourage pipo wey dey transfer money on behalf of company to educate themselves about BEC so dem no go fall victim of scam.

"Dis na challenging case, one wey involve international boundaries, traditional financial system and di internet" Jesse Baker, Assistant Director in Charge of di FBI Los Angeles Field Office tok.

Wetin dey di affidavit

Di affidavit claim say Abbas and others through BEC defraud one New York based law firm client of $922,857 for October 2019. Abbas and im gangs also use wayo make one of di law firm paralegals wire money wey wan client wan use do real estate to one bank account wey Hushpuppy and im gang dey control.

Di affidavit lso claim say Abbas conspire to launder hundreds of millions of dollars from other businesses wey no legit, including one scam to tiff £100 million (approximately $124 million) from one English Premier League soccer club.

Wetin be affidavit

Affidavit na one record wey get complains wey dem take accuse pesin say e commit crime. Every defendant dey innocent until and unless dey prove say e dey guilty beyond reasonable doubt.

If dem find out say na true im get plan to launder money, Abbas go face maximum of 20 years for federal prison.

Di FBI na dem lead di investigation wey lead to di arrest of Abbas and di United States Secret Service also give dem support.

Di Assistant United States Attorneys Anil J. Antony and Joseph B. Woodring of di Cyber and Intellectual Property Crimes Section na dem dey handle di case. Di Criminal Division Office of International Affairs provide substantial assistance for di mata.

comment to this post

Comments

Popular posts from this blog

how to clean a snake tank

HOW TO UNBLOCK YOURSELF IN WHATSAP AFTER BEING BLOCKED